66 retweeted
Once you let go of the guilt from airing people, your life would be so much brighter, you go just dey air dey go.
unna no dey live better life aje
Omo, I just hear one new format wey some guys dey use chop girls o! 😂
Dem go carry babe inside car, then branch one building site wey still dey under construction.. the site no be their own o. Dem go leave the babe inside the car with AC on, come down to greet the workers and engage them in small talks. Before dem leave, dem go bring out small cash give the workers. The babe go dey observe for inside car
Dem go now enter the car and tell the babe say the workers dey really try, say e don spend many millions on the project and still get plenty money to spend so the building go finish on time.
Omo, from that moment, the babe go begin reason am differently. She go wan loyal because she don see say the guy get serious investment and plenty expenses. She fit even begin manage herself financially, with the hope say when the project finally finish, she go enjoy the benefits too.































